|| ZOBO ||
One sip go cool my body
My strength go just wake up
Like say person wake me up from bed
E just be like alcohol
Lowkey Highness
Zobo wey thick
E con be like say I don dey addicted to cold Zobo
If I gulp zobo,e go be like say ;
God don forgive my sins
E go push away regret
Just as if say na rain fall
Morale go high
Inspiration go just dey blush for my mind
Energy go just dey do press up for my body
I no fit break up with Zobo
Wetin go fit pursue thirst if no be Zobo
The jolly-jolly wey I dey get if I just see am alone
Alcohol na for worn out people
Zobo na for active and small children like me
Today na Friday
Lemme order for 50 litre
Na zobo I go use cook this weekend
Man gast dey alright
Babe sef no dey ask for expensive wine
Zobo dan do her
As per child of God
We no fit dey on codeine diet
Abe,make person serve me ZOBO jare.
@360potential
0 Comments